Arsenal vs Liverpool: Aubameyang lead Gunners to Community Shield victory

Wia dis foto come from, Getty Images
English FA Cup winners, Arsenal don win dis year Community Shield after dem beat Liverpool 5-4 on penalty.
Aubameyang bin open di scoring during normal time before Takuma Minamino equalise for Liverpool to send di tie to penarity shoot-out.
Di Gabon international na him score di winning penalty to give Arsenal coach Mikel Arteta im second trophy wit di club after only 6 months wey im don dey in charge of di Gunners.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Teenage Liverpool striker Rhian Brewster na im miss di only penalty for Liverpool after im shot hit di crossbar.
Dis na di second straight season wey Liverpool go lose di Community Shield afta dem lose to Manchester City last year on penalties.
Traditionally, di Community Shield na im dey welcome di start of di new English season.
Di 2020/2021 Premier League season go start on 12 September, 2020.









