You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Schools resumption date: President of Ghana say secondary schools go resume by October - Guidelines for students, teachers dey here
Ghana president Nana Akufo-Addo also give go ahead for students wey dey Junior High School 2 and Senior High School 2 to resume school on 5 October to 14 December 2020 to complete dia academic year.
Dis na as goment postpone di resumption of Nursery, kindergarten, primary, Junior High School 1 and Senior High School 1 students to January 2021.
For im televised address for Sunday night, President Akufo-Addo say dis decision na afta wide consultations wit relevant stakeholders for di education sector.
Guidelines wey im give for school reopening
- Make students, teaching and non-teaching staff respect all di Covid- 19 protocols.
- Only 30 students go fit dey inside one class for di Junior High School 2
- 25 students go dey inside di Secondary High School 2 class
- Students as well as all teaching and non-teaching staff must wear face mask and goment go provide reusable face mask for dem
- Goment go provide each school wit Veronica Buckets, gallons of liquid soap, rolls of tissue paper, thermometer guns, and 200 milli-litre containers of sanitizers.
- JHS 2 student's go get access to one hot meal everyday.
- Fumigate of schools before reopening.
- Assemblies and sporting events go still dey banned; pipo wey dey outside no dey allowed to use school premises for any event. Dem go try connect any school wey no get sick bay to health facility.
Ghana presido say di kontri Education service don arrange di academic curriculum wey no go make students lost anytin even as dem no too go school dis year.
For part of im address, oga Akufo-Addo say very soon dem go decide wen sport, go fit resume but for now relaxation centres like Beaches, pubs, cinemas and nightclubs go still dey closed until further notice.