Ghana voter registration exercise: Ahead of Presidential and parliamentary elections, more than 15 million Ghanaians register to vote in December

More than half of Ghana total population don register to vote for 2020 presidential election.

Na 15 million voters for Ghana register dema names in de ongoing voter registration exercise which end Thursday 6 August.

After 31 days of de registration exercise, electoral commission capture 15,117,438 people on de new voters register.

Dis be de gender distribution as at phase 4 of se registration process where dem capture 11,629,480 Ghanaians.

Out of dis total figure gender distribution be 5,528,970 males which dey represent 47.54 percent and 6,100,510 be females which dey represent 52.46 percent.

Before Ghana Electoral Commission go start dis registration exercise, some people speculate say sometimes de EC no go fit record high turn out during de registration, but dis current figures dey prove otherwise.

Deputy Chair of Ghana Electoral Commission, Dr. Bossman Asare talk say de current figures wey dem capture dey exceed de EC en target of 15 million voters.

De current figure of 15 million go fit go up small by close of mop-up exercise where dem go finish de exercise for weekend.

Mop up exercise

Despite say de exercise go end Thursday Ghana Electoral Commission say dem dey set aside two days for mop-up.

De mop up exercise go happen on Saturday 8th August and Sunday 9th August 2020.

Next Phase of activities before elections

Regional breakdown

Out of de number of persons registered so far, Greater Accra Region capture 3,225,508 voters, dis be de region with de highest number.

Followed by Ashanti region who record 2,700,805 voters and Eastern region who dey third plus total of 1,444,274 voters.

Age distribution of voters

From de data wey EC supply, so far, de number of people wey chop 18 years on de register be 480,851.

Voters wey chop 19 years be 419,530 and voters wey chop 20 years and above be 10,729,099.

Exhibition of register

After dis registration process, Electoral Commission go exhibition of de register by September 1, 2020.

Exhibition exercise go help make people check if dem capture dema names for de register which EC go take conduct de 2020 elections.

Transfer of votes

Around October 15, Electoral Commission of Ghana go allow voters who want transfer dema votes to specific areas apart from where dem register.

Dis transfer of votes go help make people vote for places wey dem go fit visit on December 7.

Election day

After EC finish de next phase of processes, dem go now open polling stations across de country for voter to choose de Presidential and Parliamentary candidates dem go like lead dem.