Ibrahim Lawal: Neighbour of Kano man im papa lock up for 15 years bin tink say e dey school

Lawal Sheka wey be neighbour to di house wey Police go rescue 35 year old Ibrahim Lawal wey im papa lock for inside one room for 15 years tell BBC say for di 15 years wey dem no see di man dem think say e dey school.
Na on Sunday a team of Police go rescue Ibrahim for Sheka area of Kano city wey dey for northern Nigeria.
According to Lawal, before Ibrahim disappear dem dey aware say e get some mental problems and dat di father dey try im best on di problem.
"After yesterday (Sunday) wey police enter our area come rescue Ibrahim, all of us dey shocked and surprise because many no know say Ibrahim dey inside dat house all dis years."
"Like me, many pipo for di area think say Ibrahim dey Maiduguri for Quranic school because some of im brothers dey dia also."
Di neighbour also tok say to di best of im knowledge Ibrahim father, Mallam Lawal Unguwar Fulani no dey show any strange behaviour and na even imam for dia local mosque.

"Dis na pesin wey I dey greet everyday, I no observe any strange behaviour from di father for all dis years infact na im be di Imam for our local mosque for di area."
'Expect more rescues'
Comrade Haruna Ayagi na oga for Human Rights Network wey dey Kano and im group dey involved for di two rescue missions, e tell BBC say e dey expect more of dis kain rescue in di coming weeks as dis type of cases plenti.
End of Di one wey oda users dey read well well
"If you observe you go see say dis na di second case for Kano in just few days not adding di Kebbi state own and by di look of things I dey expect more cases of dis nature."
"Wetin dey happun be say poverty na major issue for wetin dey happun. Mostly parents wey dey lock up dia children dey poor and wen dey observe say di children get mental or any oda issue dey resort to dis kain action as dem no get money to take medical care of those children."

Haruna add say na goment suppose provide structures wey go helep parents wey get children wey need special care and dem don fail for dat one.
Kano Police Command tok tok pesin DSP Abdullahi Haruna confam di rescue of Ibrahim and add say dem dey with im step mother at di moment as dey dey continue to investigate wetin happun.
E add say dem still make efforts to arrest di father of Ibrahim wey still dey at large.











