International flights resumption and university reopening in Ghana go begin afta months of Covid-19 restrictions

Ghana go begin international flight for di kontri by 1st of September dis year.

President Nana Akufo-Addo give di go ahead afta e review di Coronavirus situation onto say active cases don dey reduce for di kontri.

Inside one televised address to di nation on Sunday, President Akufo - Addo say di decision to reopen di airport to international flights go depend on whether dem go fit test all di passengers wey enta di airport.

Di move na prevent further spread of di virus in kontri. About twenty four thousand five hundred (24,500) passengers arrive for di Kotoka International Airport everi week.

Domestic flights don alreadi dey operate for di west African kontri.

Di president also announce further relax restrictions and reopening of higher schools alias tertiary institutions inside di kontri next week.

Director General of di Ghana Health Service Dr Patrick Aboagye don tok say dem go do exercise ontop di mata dis week to know di kontri strength to test all di passengers as dem arrive.

Dem dey consider adopting di covid-19 rapid testing system at for di airport next week.

Covid-19 cases don see huge drop from over three thousand active (3,3007) cases inside di last three weeks to more than one thousand active cases (1,847) as of Saturday.

Di kontri don so far cari out over four hundred thousand (427,121) covid-19 tests.