You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Beirut Explosion: Resignation of Lebanon Prime Minister Hassan Diab and Lebanese goment
Di entire Lebanese goment don resign afta Tuesday huge explosion wey happun for Beirut.
During di angry address to di nation di outgoing Prime Minister, Hassan Diab vex for wetin im call corrupt political establishment, wey im say dey disturb di work of im gomment.
Di goment don bin dey under serious pressure to step aside afta di blast.
Many Lebanese dey vex say authorities allow make dem store large quantities of explosive material for Beirut port.
Plenti streets protests na im don go on, and some demonstrators don storm and ransack ministry buildings.