Juventus UEFA Champions League: Maurizio Sarri chop sack afta Lyon 2 - 1 defeat

Wia dis foto come from, Getty Images
Juventus sack Maurizio Sarri as manager on Saturday just afta one season.
Di Italian giant announce for dia twitter handle say dem don relief Maurizio Sarri of im post as coach of di First Team, Juventus Football Club.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Dem appoint Italian Sarri, 61, on a three-year contract last summer afta one year for Premier League club Chelsea.
Juventus lose three of dia last four league matches to finish only one point clear of Inter Milan for di end.
Napoli also beat dem for di Coppa Italia final as dem restart football afta di coronavirus shutdown.
Juventus na two-time European Cup/Champions League winners but dem neva lift di trophy since 1996.
Former banker Sarri bin coach 16 different sides for di lower divisions of Italian football before im reach Serie A wit Empoli for 2014.

Wia dis foto come from, EPA
Afta three years for Napoli, he move go Chelsea wia im finish third for di Premier League and win di Europa League for di first season wey im dey in charge.
End of Di one wey oda users dey read well well
He later take ova from Massimiliano Allegri for Juventus for June 2019 and become di oldest manager to win Serie A.
Di club say dem go like thank di coach say im write a new page for di history of di club wit di victory of di ninth-consecutive championship, plus all di personal joni wey lead am to climb all di divisions of Italian footballT.
Dis sack dey come as Juventus drop comot from dia UEFA Champions League round of 16 afta dem lose to Olympique Lyon.
Wen he dey tok afta Friday match, Juventus president Andrea Agnelli say di season bin dey "bittersweet". He say even wit di Serie A triumph, dia Champions League performance dey "disappointing" and need dey for "cold and lucid analysis".











