Big Brother Cameroon: How Biggy 237 kitchen fire explode inside housemates mansion

#BIGGY237: Fire Incident Inside Biggy237 Mansion

Wia dis foto come from, ScREENSHOT/YOUTBE VIDEO

Read am in 2 mins

Fire catch inside kitchen for Biggy 237 mansion yesterday but e no burn any man.

Housemates quench de fire as all of dem join hand make de fire no spread.

Di kitchen fire explode late Thursday night.

Cyril Akonteh, managing director for Biggy 237 don tell BBC News Pidgin say, "fire start from microwave weh deh no handle'am proper".

'Housemates panic wen fire start but deh realise say deh fit manage de situation, deh quench de fire, tins return to normal", e add.

See how fire explode inside Big Brother Cameroon mansion

Cameroon di start e first reality show, Biggy 237 on August 2, 2020.

Di show go focus on peace and how pipo from English and French side fit live together.

Peace bi important especially for taim weh Cameroon di struggle wit Anglophone crisis and oda issues, Cyril Akonteh, de managing Director tell BBC Pidgin.

Social media reactions dey pour ontop di mata

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Weti you get for know about Biggy237

At de end of de show, de winner go get $17820 (FCFA 10million) plus gifts and dream trip for Dubai.

De concept di promote de two languages for Cameroon, di project and unite young pipo from from de two cultural backgrounds.

Since weh de world di battle Covid-19, de show go educate pipo how for live and cope, especially how for prevent and protect demselves from dis pandemic.

Na 25 young boys and girls of above 21 years go enta Biggy Mansion for August, 2, 2020 wit entry party.

But before now, deh go don pass dia medical exams and deh go check dem for Covid-19 before deh enta de mansion.

De bi don quarantine sef from 18 July afta deh bi don do plenti medical check-ups, HIV, hepatitis B and C, Chlamydia, chest X-ray and Covid-19 test.

From 27 July, deh contestants go meet for Denver Residence for isolation before de show proper start.

De housemates go tok English, French and pidgin and Francanglais.