TikTok: Why US President Trump wan ban TikTok video app wey dey ginger for Nigeria

Wia dis foto come from, EPA
America President Donald Trump don announce say im go ban TikTok, Chinese video app for America.
Oga Trump wey wan go enta im plane, Air Force One tell tori pipo say im go sign executive order to ban di app. E say "Forget TikTok, we go ban dem from di United States."
Security officials for America dey worry say Chinese fit dey use di app collect personal data of di pipo wey dey di kontri.
Na one Chinese firm ByteDance get di app and dem don deny di accuse say na Chinese goment dey control dem and goment get shares for di company.
Di app get 800 million active users for America and di ban go affect ByteDance well-well.

Wia dis foto come from, Getty Images
E neva dey clear if Oga Trump get right to ban TikTok, how im go take enforce di ban or how im go take handle wetin di law tok for dis kain mata.
But one tok-tok pesin for TikTok say im get confidence say TikTok no go comot for America.
Di move to ban TikTok dey come for period wen kwanta dey between Trump administration and di Chinese goment on top mata wey include trade wahala and di way dem take handle di coronavirus outbreak.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin be TikTok

Di app just begin dey gain popularity recently and na young pipo full am.
Di social network na for amateur music videos and lip sync videos. Users fit make dia own or just siddon to watch oda pipo own.
Dem go come share dis videos to dia followers and even pipo wey dem no sabi. Dem do am like say all accounts dey public where anybody fit see di video you send. But pipo wey dey use am fit decide who dem want make e see di videos dem share.
Tikok also allow pipo to send private messages wey na only friends go fit see.
Over 800 million pipo dey use TikTok every month and most of di users dey US and India.
Many celebrities use am during di lockdown to connect with dia fans.
India don already ban TikTok and all oda Chinese apps. Australia, wey don before now ban Huawei and telecom equipment-maker ZTE, also dey reason to ban TikTok.
Why Trump no like TikTok
Di reason why Oga Trump no like TikTok pass di privacy excuse wey im give.
Di presido and Chinese goment don dey enta each oda since di coronavirus outbreak as Oga Trump blame Chinese for di way dem take handle di virus.
Anoda reason why Trump no like TikTok na because some users scata di campaign rally wey im do for Tulsa.
Why US dey worry about TikTok

Wia dis foto come from, Reuters
US officials and politicians dey worry say ByteDance fit give di Chinese goment information and data wey Americans dey release for TikTok.
TikTok dey operate dis kain app but separate version for China wit different name Douyin. Dem say all US data dey stored for di US and e get backup for Singapore.
Di CEO of TikTok, Kevin Mayer post say "we no be politicians, we no dey collect political advertising and we no get political agenda, our objective na to be one ogbonge platform wey pipo fit come enjoy,"
"TikTok get di largest number and we no be di enemy."
TicTok na very popular apps wey many Nigerians dey use especially celebrities.
E dey ginger Nigerians
During di lockdown, many Nigeria celebrities use TikTok take connect wit dia fans and many pipo also dey gain popularity from dis app.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1

End of Instagram post, 2

End of Instagram post, 3

End of Instagram post, 4

End of Instagram post, 5

End of Instagram post, 6

End of Instagram post, 7
TikTok na made in China video sharing social network and na Zhang Yiming be di founder. US senators don criticise di social network app say dem dey worry about pipo privacy and child safety rules for di platform and dem say because na Chinese company get am, dem fit censor content of users based on wetin China like or dem no like.
But TikTok don come out to say dem get moderation team wey dey go over content and dem go block di ones wey no dey appropriate for users wia possible.