BBNaija housemates Eviction, Saturday night party and oda tins wey go happun next for di reality television show

Wia dis foto come from, BBNaija/Twitter
Voting don close for di housemates wey dey up for possible eviction dis week inside di Big Brother Naija Lockdown house.
Dis week, 18 out of di 20 housemates dey up for eviction afta Biggie introduce new twist to di game.
Na only di Head of house Lucy and her deputy Prince wey get immunity for di house.
On Sunday August 2, fans of di show go find out which housemate go be di first to leave di house during di live television show.
How di Live Eviction go work dis season?

Wia dis foto come from, BBNaija/Twitter
Every Sunday di housemates go take part for di live eviction.
Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room.
Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house.
Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show.
End of Di one wey oda users dey read well well
Saturday night party

Wia dis foto come from, BBNaija/Twitter
Saturday night party inside di house na one of di main highlight for di housemates and fans of di show.
Na for di party housemates dey show some of dia best dance moves, and na part of wetin Biggie dey use spice tins up for di house.
For last week party, Biggie bring Sarz and Omah and di housemates groove like say tomorrow no dey.
During di live eviction show, Ebuka Obi- Uchendu wey be di show host hail Erica and Laycon for dia dance move and ginger for di party.
Di housemates dey really look forward to dis week party as e go di last time all 20 of dem go party togeda inside Biggie house.
Arena Games

Wia dis foto come from, AFricanmagic website
Di first Betway Arena Games no go well for most of di housemates as most of dem make plenty mistake.
Brighto tear im gloves, Eric pour di chemicals all ova himself and Neo wrap im hair net wey don tear ova im head. As for Vee, she no bin want her fellow housemates to clap for her.
Di theme of di game centre around coronavirus.
Lilo and Nengi na dem go far pass, and as consolation, dem no comot ten seconds from dia time.
Dis season di housemates go spend ten weeks for di house as dem compete dey for di grand prize of N85 million naira.











