Pastor Chris Oyakhilome react to government coronavirus lockdown rules for church plus Covid-19 treatment and vaccine claims

Wia dis foto come from, Youtube/ Pastor Chris Oyakhilome
For service wey im do online on Friday 31, July, 2020, Pastor Chris Oyakhilome, di founder of LoveWorld Incorporated alias Christ Embassy, condemn goment regulations on churches sake of di ban wey dem put for religious gatherings for di kontri.
Nigeria Presidential task force on Covid-19 bin give order to limit time wey pipo go fit stay for churches and mosques to control spread of coronavirus.
For di guideline wey dem release for di reopening of worship centres, dem limit di duration of service to one hour at a time and only on Sundays.
But Pastor Chris no too happy about di rule. "If you think say church no go come back, you dey lost. We go come back stronger and more powerful. Di only voice wey fit control us na dat of Jesus Christ."
"Christians around di world don respect goment so far and dey wait for dem to do right thing. But if you no open church soon, we go break all rule as we dey always do and you fit do as you like, we no care"
"I dey shock say some pipo get di audacity to tell us how many hours we fit spend for church. How dare you?
"Wetin you tink say you be? Your time dey short. You no fit tell God's pipo how long dem fit spend for church." Na so di Pastor tok during di online service.
Di Pastor also react to sabi pipo claim say cure for coronavirus and vaccine don dey.
End of Di one wey oda users dey read well well
Pastor Chris wey don tok plenti controversial tins since coronavirus pandemic start, say some pipo no like di drug wey doctors dey campaign say e fit cure di virus but dem dey use am.
Dis reaction dey come afta video of one doctor for US, Dr Dr Stella Immanuel bin go viral .
For inside di video, di Cameroonian doctor bin claim say hydroxychloroquine na cure for coronavirus.
Faccebook, Twitter and YouTube pull down di video say di Doctor dey spread information wey no true and promote drug wey di World Health Organisation (WHO) no sanction.
Plenti gbas-gbos don happun since den, as pipo dey criticise Dr Stella Immanuel for her claims say hydroxychloroquine dey work for all patients wey get coronavirus infection.
Pastor Chris tok for inside video wey no mention di name of any doctor or drug say make : "pipo for Africa dey wise".
"Make you sabi say you dey di agenda. Even if dem give di drug to everybodi, dem no go let you know" he tok.
Pastor Chris claim say di West no want make Africans use di drug na why dem dey shut down di claim be dat.
"Dem don complain say una too plenti but una be minority for di world. Why dem wan comot you na say you dey too smart and dem be dey afraid of you". He add am.
Di pastor say make Africans create dem own drugs and vaccine and no wait for obodo Oyinbo to ship one come.
No be di first time Pastor Oyakhilome dey tok hard ontop dis pandemic palava. Im be tok before say na 5G dey cause coronavirus even as World Health Organisation don tok say no link for 5G and coronavirus.
Big big social media platform like Facebook and Periscope don even comot di video of di pastor for di platform sake of say e dey spread wrong informate about coronavirus.












