You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Victor Osimhen: Nigeria striker don become di most expensive player for Africa after Napoli confirm dia deal
Italian Serie A side Napoli don confam di signing of Nigeria striker Victor Osimhen from French club Lille.
According to French sports newspaper L'Equipe di deal worth more than $96 million (81.3m Euros) wey make am di most expensive African player of all time.
Napoli don pay pass wetin English side Arsenal pay Lillie for Ivory Coast Nicolas Pepe last year.
Osimhen join Lille from Belgium Charleroi to replace Pepe.
He score 18 goals for all di competitions for Lille last season.
For some weeks now na im pipo don dey reason say Napoli go sign di 21 year old.
For June, dem name Osimhen player of di season for Lillie. For im first campaign for France, dem also give am Ligue 1 team of di season.
See as Victor Osimhen football career take waka
Osimhen bin enta spotlight for 2015 Under-17 World Chile as he win di Golden Boot and Silver Ball awards wen e still dey play for Golden Eaglets..
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 16-year-old score tournament record 10 goals, and e play well wey make am win di award for Africa Youth Player of the Year for 2015.
Di international footballer performance for Chile World Cup carry am go Wolfsburg but Osimhen no play for Arsenal instead im play in Germany Bundesliga. He tok say e no easy to dey play for both league and European football but im dey try adjust.
For one season di striker no play sake of injury, he later move go Belgium wia im begin dey score more goals. He score 19 goals for Charleroi Belgium, where he dey on loan before dem permanent am.
Victor Osimhen tweet im no fit wait to wear di jersey and change na constant thing. He add say im dey sure say im mama and dey proud
Many of im fans don enta social media to congratulate am.