Agnes Reeves-Taylor return to Liberia: Who be Charles Taylor wife wey bin dey prison for war crimes

Agnes Taylor pictured with a gun

Wia dis foto come from, Patrick Robert/Getty

Wetin we call dis foto, Agnes Taylor (far right) face accuse say she follow join di pipo wey use rape to torture women during di 1990 war

Agnes Reeves-Taylor, di ex-wife of Liberia former President Charles Taylor, don return to Liberia, after one UK court troway charges of war crimes against her.

For 2017, dem charge her wit crimes - some wey involve pikin dem - during di civil war for di West African kontri. She deny all di accuse.

Her ex-husband dey do life sentence for im war crimes for Sierra Leone.

Supporters of oga Taylor National Patriotic Party (NPP) don dey hail di return of Ms Taylor ontop social, as some dey crown as "di founding mother' of di former ruling party.

She bin dey UK prison for charges wey relate to war crimes from 1 June 2017 up till December 2019 when court for Britain conclude say evidence no reach to finger Ms Taylor as guilty.

Agnes Taylor (date unknown)
Wetin we call dis foto, Agnes Reeves-Taylor bin work as lecturer and head of department for Coventry University

Who be Agnes Reeves-Taylor?

  • Dem born am on 27 September 1965 for Liberia
  • She marry Charles Taylor for 1986
  • She move to UK for 1998
  • Her LinkedIn profile show say she bag MSc Financial Management from Middlesex University (1998-1999); PhD, Business Administration from University of Hull (2000-2005)
  • For 2012 she begin work as lecturer for Coventry University
  • On 1 June, 2017: UK Met Police arrest and charge her with war crimes
  • On 19 October 2018: She deny all 8 charges
  • UK authorities deny her application to remain in di kontri forever
  • On 6 December 2019: UK court on 16 dismiss all charge against her

Her former husband, Oga Taylor serve as president of Liberia from 2007 to 2003. Di civil war wey e fight inside claim di lives of about 250,000 between 1989 and 2003.

Currently, Charles Taylor dey do life in prison from war crimes inside neighbouring kontri Sierra Leone.

As for madam Agnes. e no dey clear if di former university lecturer, get plan to enta politics now wey she don Liberia.