Liberia don ready to do second round election

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO
Liberia don ready to do dia second round presidential election.
Dem bin delay am before after Charles Brumskine of Liberty Party, wey come third for di first election, carry case go court say wayo dey inside.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Supreme Court last week dismiss di case, wey mean say make di election continue.
Electoral Commission oga, Jerome Korkoya, say dem don arrange 26 December as di date wey dem go do di second round.

Wia dis foto come from, Reuters/ EPA
Na former footballer George Weah go enter di same trouser with Vice President Joseph Boakai for dis one after dem finish first and second for di first round.

Wia dis foto come from, Getty Images
Korkoya also talk say make dem start to dey campaign sharp-sharp but di campaigning must to stop on 24 December.

Wia dis foto come from, SEYLLOU
Di winner for dis second round election go replace Ellen Johnson Sirleaf as president and go be di first time wey one person go handover power to another peacefully for di first time in 70 years.
Johnson Sirleaf don dey run di country now for di past 12 years and Liberians don dey lick mouth dey wait for di next person wey go carry di country forward.
End of Di one wey oda users dey read well well










