You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kidnapping in Nigeria: Police recover Ereba Gospel Dinabari skeleton afta kidnappers collect ransom still hang am to death for Eleme area of Port Harcourt
- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
Police don recover di rotting skeleton of one 38 year old kidnap victim, rom one thick bush for Rivers State, southern Nigeria.
Rivers State Police Command identify di victim as Ereba Gospel Dinabari, afta dem discover im deadibodi for Alesa, Eleme Local Goment Area (wey be town wey dey around 20 kilometers east of Port Harcourt) on Wednesday 15 July.
Police tok tok pesin Nnamdi Omoni, wey cari tori pipo go di bush wia di carcass of Dinabari dey, say operatives of di Anti-Kidnapping Unit (of Rivers State Police Command) as dem dey investigate di kidnapping, arrest two suspects, 25 years old Osondu Uchendu and 23 year old Amebulem Amos for Alesa Eleme and na dem go show dem wia di deadbodi dey.
According to police, one of di main suspects Osondu Uchendu cari police and tori pipo go di Alesa bush wia e confess say him and e gang tie Dinabari to one tree till im die.
Uchendu confess say na on 15 May, 2020 dem kidnap Dinabari for Woji, Port Harcourt come demand One million naira ransom. But afta di family pay di ransom, dem no release am but come kill am for di bush. Police add.
Police tok tok pesin Nnamdi Omoni say dem go charge di suspects to court after dem conclude dia investigation as dem also recover di Toyota Camry car (Spider) of di victim from di suspects, wey also confess say dem don kidnap plenty pipo around Woji, Abuloma, Peter Odili Road for Port Harcourt and also for Eleme communities.
Dis na one crime too many for Pitakwa
Dis no be di first time dis kain crime dey happen as e never too tay for May 2020, Police for Rivers State southern Nigeria on Friday dig out di deadibodi of three students: two males and one female wey dey school for University of Port Harcourt.
Kidnappers bin don gbab di students; Nelson Nwafor, Fortune Obemba and Joy Adoki on 7 April, 2020 from Choba, one of di host communities of di university and during investigation, on 30 April, 2020 police arrest three of di suspects, na wetin police tell BBC Pidgin.
End of Di one wey oda users dey read well well
For December, 2018 wey police bin don dig out di deadibodi of one girl, Ozigie Wovueze from di bedroom of her boyfriend, Ndema Owabie AKA JBoy for Wimpey area of Rumuepirikom inside Port Harcourt.
For November last year, police also comot one woman, Charity Ohaka wey her killers troway her deadibodyiinside well for Rumuosi (one area wey dey close to University of Port Harcourt) and about three years ago, tori of one Jumia delivery man wey dem kill and bury for soakaway, for Ada George area of Port Harcourt, too bin dey trend.
Few months ago naim police go exhume di three deadibody of students of University of Port Harcourt and Rivers State University from ETEO bush for Eleme, wia kidnappers bin also go bury dem dia.