Gokada founder Fahim Saleh: New York police find di tech entrepreneur 'murdered' for im New York apartment

    • Author, Faith Oshoko
    • Role, BBC Pidgin
  • Read am in 2 mins

Police don find di dead bodi, of di oga of Gokada, Fahim Saleh, 33, for im house for New York, America.

Officials tok say dem find im body wey dem cut, with electric saw beside im scattered bodi.

Di Pilots Operation Manager for Gokada, Victor Daminabo confam to BBC Pidgin say say true-true, e don die, even as e describe oga Saleh say im be "a man of di pipo."

E say, "my relationship with oga Selah be more than oga and employee. Im be great guy".

Police for di area tok say video from one security camera for di area bin show video of oga Selah dey enta elevator with one man wet wear black suit and black mask.

Di New York Police for statement tok say "Dem receive 911 call for assault for East Houston Street wia dem find man wey dey unresponsive and unconsious man for house. Na later EMS say e don die. For now, investigation still dey go on and di medical examiner go tok how e take die."

Gokada also post for inside dia oga wey dem call "great leader and inspiriation and positive light to all."

Saleh start Gokada for Nigeria for 2018 wey be bike (okada) hailing service but Lagos government bin ban okadas for di state early dis year.

Who be Fahim Saleh?

Dem born di 33 year old businessman for SaudiaArabia to Bangladesh parents and later na im all of dem come relocate enta New York, America.

E start to dey develop love for coding and all dat kain tin wen e be teenager.

Fahim Saleh na techpreneur wey start Nigeria okada hailing service, Gokada for 2018.

But no be dat time e start to dey work on di tech space. For 2009 after e graduate from Bentley University for Massachusetts, United States of America, e start di app PrankDial, wey be app wey dey make random prank calls give different pipo.

Gokada for Lagos, Nigeria no go be di fist ride sharing company wey im create as im also create Pathao for im home kontri of Bangladesh for 2015.

Tori be say di ride sharing app wey dey valued at about $100 million na di biggest ride sharing app for di kontri.