You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Okada ban in Lagos: See oda ways to move around lasgidi witout 'Okada or Keke'
Lagos State Goment announce say from 1 February, 2020 dem no allow go commercial motorcycles (okada) & tricycles (keke) to work again for some local goment for di state.
Di ban affect 6 Local Goment and 9 Local Council Development Area.
Di goment ban 'Okada,' 'Keke' pipo to operate for express road and on top bridge dem for di state sake say from 2016 to 2019, over 10,000 accidents na im General Hospitals alone don record.
Oda sharp sharp ways dey to take move around for Lagos?
Estate Shuttle
Shuttle for estates inside Lagos no be new tin as means of transportation to areas where di community don ban Okada or Keke even before goment do dia own. Tori now be say shuttle fit extend reach oda areas.
BRT:
Dis seater bus get terminal for bus stops wey dey across Lagos to cari pipo from dia destination go anoda one
Bus - Molue
Di popular yellow bus wey dem dey call 'Danfo' na anoda sharp-sharp means of transportation for Lagos. Some dey wit for bus stops to cari passenger and some dey roam upandan incase some passengers dey far from bus stop
Yellow Taxi
Di Yellow taxi don almost no dey popular again since Uber don show face for di economic hub. But as e be so, di demand for dis taxi fit become hig as na anoda way to survive no-okada lagos.
Taxi hailing app
Since ova 5 years wey di Taxi-apps don become di trend for pipo wen dem get waka within di state, di end no dey near as di app go save pipo wey wan go work or run errands to places wia bus no go fit reach within di area wey dem don ban Okada and Keke.
End of Di one wey oda users dey read well well
Apart from Uber and Bolt, e get at least 10 oda taxi hailing apps wey fit carry you waka around Lagos.
Uber boats
Taxi hailing app company UBER don tier rubber dia first ever boat ride for Lagos state, south west Nigeria to help reduce plenti traffic jam inside di state.
Dis na first time di transport company go launch boat ride for African continent and yousef fit use am..
Lagos wey be Nigeria major business area for Nigeria, dey experience heavy traffic jam everi day and dis dey affect work, business plus oda activities for di state.
Lagos and di okada ban
Many pipo wey dey live for Lagos - wey be di commercial capital of Nigeria - dey use motorcycle and tricycle daily to go about dia daily lives.
Na ova 21 million pipo dey live for Lagos, according to National Population Commission of Nigeria.
Di worry of many commuters for di city na say goment no provide alternatives before dem announce di ban on Monday January 20, 2020.
Tori be say dis move go affect plenty pipo afta e take effect from Saturday February 1, 2020.
Gboyega Akosile, Di Chief Press Secretary to Lagos State Governor, Babajide Fashola, enta social media on post di reasons why di goment dey take di decision to ban Okada and Keke for di state.
Pipo enta social media to tok how di ban dey affect dem say goment no tink to provide oda means wey pipo go fit move around sharp sharp for di city.
See di places wia 'Okada,' 'Keke marwa' no go pass
Major express roads dem
- Lagos Ibadan Expressway
- Apapa Oshodi Expressway
- Oworoshoki Oshodi Expressway
- Lagos Ikorodu Expressway
- Lagos Abeokuta Expressway
- Babangida Bouleverde
- Eti-Osa Lekki Epe Expressway
- Lagos Badagry Express
- Funsho Williams Avenue
- Agege motor Road
- Eti-Osa Lekki Coastal Road
Bridge dem
- Iyana-Ipaja Bridge, Agege/Alimosho Local Government
- Dopemu Bridge, Agege/Alimosho Local Government
- Airport/Ikeja Bridge, Ikeja Local Government
- Agege Motor Road/Oshodi Loop, Oshodi, Ikeja/Mushin Local Government
- Mushin/Isolo Link Bridge, Mushin Oshodi Local Government
- Dorman Long Bridge Surulere/Lagos Mainland Local Government
- Ojuelegba Bridge, Surulere/Lagos Mainland Local Government
- National Stadium Flyover, Surulere Local Government
- Iganmu/Funsho Williams Bridge Surulere Local Government
- Apapa - Iganmu Bridge Surulere local goment
- Apapa - Ijora Link Bridge, Apapa/Lagos Mainland local goment
- Liverpool Bridge, Apapa, Apapa local goment
- Mile 2 Bridge Loop, Amuwo-Odofin, Amuwo-Odofin local goment
- Okota (Cele)/Ijesha Link Bridge Mushin/Oshodi-Isolo local goment
- Apakun/Apapa-Oshodi Bridge Network, Mushin/Oshodi/Isolo local goment
- Ikorodu Road/Anthony Cloverleaf Bridge Somolu/Ikeja Local goment
- Trade Fair Flyover Bridge, Ojo local goment
- Festac/Amuwo-Odofin Link Bridge Amuwo Odofin local goment
- 2 Flyover bridges along Alhaji Masha Rd, Surulere local goment
- Ojota Clover Leaf Bridge, Kosofe/Ikeja local goment
- Ogudu Bridge Kosofe local goment
- 3rd Mainland Bridge Lagos Island/Mainland/Somolu local goment
- Maryland flyover Ikeja/Somolu local goment
- Ikeja/General Hospital flyover Bridge Ikeja local goment
- Kodesho Bridge, Oba Akran, Ikeja, Ikeja local goment
- Opebi Link Bridge, Ikeja local goment
- Sheraton-Opebi Bridge, Ikeja local goment
- Jibowu/Yaba flyover Bridge, Lagos Mainland local goment
- Carter Bridge Lagos, Lagos Mainland local goment
- Bariga-Ifako Bridge Somolu/Kosofe local goment
- Apapa - OShodi Expressway/Alapere Bridge Somolu/Kosofe local goment
- Bariga/Oworonshoki Bridge Somolu/Kosofe local goment
- Apapa - Oshodi Expressway/3rd Mainland Bridge Somolu/Kosofe local goment
- Apapa - Oshodi Expressway/3rd mainland Bridge Somolu/Kosofe local goment
- 3rd mainland/Oworonshoki Bridge Kosofe local goment
- Eko Bridge Lagos Island/Lagos Mainland local goment
- Apongbon flyover, Bridge Lagos Island local goment
- Cowry Bridge (Officers Mess) Lagos Island/Eti-Osa local goment
- McWen Bridge (Bonny camp) Eti-Osa local goment
- Marina/Ikoyi Bridge Lagos Island/Eti-Osa local goment
- Ikoyi/Obalende Bridge Eti-Osa local goment