Nigeria schools resumption: Why Nigeria goment wan pay salary of private school teachers wey dia school dey owe dem

Private school teacher

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Di Nigeria federal goment don agree to pay salary of private teachers wey dia school dey owe dem, di president of National Association of Proprietors of Private Schools, bin confam to BBC.

Yomi Otubela, wey dey head di association say dia members (wey be school owners) go fit get small relief afta di gbege wey Covid-19 lockdown wey start for March don cause dem.

For statement wey Otubela release give BBC on Monday 13 July, e say private schools follow for di N2.3 trillion stimulus money wey federal goment bin announce di week before.

Statement wey joinbodi NAPPS release say dem bin carry dia request go di federal goment through di Economic Sustainability Committee wey Vice President Yemi Osinbajo dey and now, di Federal Executive Council don approve am.

Di Nigeria Senate website list private schools as one of di kain business wey goment go support.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

When BBC ask Otubela how many months of salary di goment go pay, im reply say "dem never decide dat one now. Di coronavirus still dey on, what if e last reach December, wetin go come happun?".

E also no fit tok when di goment agree say dem go begin pay di teachers. "Di goment still dey package di arrangement," di association oga bin tok.

And how di goment go sabi which of di teachers never collect salary?

"Na our job be that, we get list of members and we get way to take sabi who and who never pay dia workers and go need di money," Otubela bin reply.