Omohtee: 'Fat wey don turn to doti dey comot from my bumbum surgery wey I do' - Victim of 'failed bum surgery'
Producer: Ogechi Obidiebube
My whole bodi cold wen 'Omohtee' raise her blouse to show me all di deep scars wey dey all over her lower waist.
Scars wey she no feel comfortable to show wen di interview proper start.
Omotola Taiwo, wey pipo sabi as 'Omohtee' share details of how di cosmetic surgery wey she do don affect her mentally, physically and financially sotay she bin dey reason to kill hersef.
Di 28-year-old wey dey run Toj Fabrics, open up about di different fluids wey dey comot from her bodi and di pains wey she still dey feel six months afta her surgery.
Omohtee wey bin do 'top up' liposuction and Brazilian Butt Lift surgery as far back as January, 2020 for Lagos, Nigeria don come out now to accuse her surgeon, Dr Anu Adepoju say she do failed surgery for her wey don cause her serious health complications.
Dr Anu wey dey sue Omohtee for N25 million ontop defamation charges, also share her own side of di tori.
She insist say she be qualified Doctor and Cosmetic Surgeon wey don train wit different ogbonge medical institutions and claim say she get over 1,000 successful surgeries to her name.
Dr Anu say dis whole matter don make her lose over N100 million ($25,7731) from her clinic, Med Contour wey goment authorities don lock up.
Video: Gift Ufuoma
You fit like to read dis beta tori dem:
- Abandon sick student of KNUST SHS die sake of Covid-19 fear - See what we know so far
- See wetin hapun for Lagos local airport as flights resume today - Fotos
- One in evri 100 pipo get bipolar disorder - Dis na wetin you need know about dis mental health condition
- After EFCC chairman, Umar na di most senior cop for Nigeria corruption police
- See how Dubai don beef up internet security afta dem arrest Hushpuppi
- How English Premier League table dey look like now
- See di prison wia FBI keep Hushpuppi
- Jeff Bezos fit become di world first trillionaire


