You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Dr Anu: Fed goment don arrest woman wey pipo accuse of fake bumbum operation
Di Federal goment of Nigeria don arrest one Dr Anu (Medcontour) and charge to Federal High Court, Ikoyi, Lagos.
On Friday, 4 July, Federal Consumer Protection Council (FCCPC) announce di arrest of Dr Anu wey her real name na Anu Fella, ontop accuse say she no cooperate with investigation into allegation of medical anyhow practice.
Dr Anu and her company don trend for social media many times over di last two years when pipo go comot to accuse am say di cosmetic surgery she do ontop dia breast or bumbum come make dem worwor, or cause dem serious injury.
She don always comot to deny di accuse.
On 15 April, authorities close Medcontour office for Lagos ontop accuse of "illegal activities" and say investigation go begin.
According to informate wey FCCPC release on Friday, dis arrest and criminal charge na because Dr Anu no comply with di commission requirements for di investigation and say she no give dem di informate dem ask her for.
Oga of FCCPC Babatunde Irukera, wey imsef na lawyer, go be di lead prosecutor for di case.
Accuse against Dr Anu
Caution: Di video below fit disturb some pipo
End of Di one wey oda users dey read well well
Di number of pipo wey wan do surgery to change how dia body be for Nigeria don dey on di rise.