You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ghana coronavirus update: Covid-19 recoveries for de kontri catch 10,074
Covid-19 recoveries for Ghana rise catch 10,074, one of de highest recoveries in one day.
Ghana Health Service reveal say some 5,526 people be de latest to from de disease.
De jump in recoveries be sake of de new discharging protocols wey WHO introduce.
Sake of that health officials for Ghana dey count recovery and discharge together.
Before dem dey do three tests before dem go discharge people wey test positive.
But now dem dey discharge patients who be asymptotic after 14 days.
Ghana record 514 new Covid-19 cases which push de total number go 13,717.
Sake of de recoveries, total active cases now be 3,554.
End of Di one wey oda users dey read well well
Meanwhile de death toll rise catch 85 after 15 people die in one day.