Coronavirus: Ghana record en first COVID-19 recovery case

First COVID-19 patient recover for Ghana after de virus enter de country.

De patient wey recover be one of de first cases wey de country around March 12.

Ghana Health Service announce de recovery for dema covid-19 website on Thursday, March 26, 2020.

Health officials say de COVID-19 patient after treatment dey test negative now.

Ghana Health Service say so far 49 people dey respond to treatment, 1 person dey inside critical condition wey 3 people die so far.

Meanwhile, Ghana Medical Association (GMA) dey call on govment make dem declare nationwide lockdown.

Dem say de lockdown for affect everything except people who dey offer essential services.

"GMA be conscious of de threat and disturbing trend of community spread plus de inadequate capacity for de country health system to deal with increased COVID-19 infections."

"President of Ghana for declare nationwide lockdown with de exception of essential services immediately" GMA President, Dr Frank Ankobea sign for statement inside.

So far de kontri don record 132 cases of coronavirus, 54 from regular surveillance from de country den 78 cases wey dem pick from travelers wey dey under mandatory quarantine.