Coronavirus-Virus: Nine African kontris wey get travel ban ontop COVID-19 spread

As di coronavirus dey continue to spread, many Kontris for all ova di world don advise dia pipo make dem no travel and some don even put dia pipo on hold untill di COVID-19 disease pass.

In fact, na around forty kontris don get some kain of bans for dia airports and for foreigners.

See African kontris wey don issue travel ban

See African kontries wey restrict travel

As dis one dey happun, restrictions dey happun all ova di world. Di most recent be say di European Commission wan make travel between di Europe free travel kontris to dey on only compulsory basis.

So far around di world, di number of coronavirus cases don rise to 188,638 and kill 7,511 pipo.