Ibidunni Ighodalo funeral service: Family and friends say final goodbye to di Pastor of Trinity House Church and Elizabeth R founder

Wia dis foto come from, TY BELLO
- Author, Olubunmi Okunnu
- Role, Broadcast Journalist
- Read am in 4 mins
Family and friends don say goodbye to di late Ibidunni Ighodalo, di wife of Lagos-based pastor and founder of Trinity House, Pastor Ituah Ighodalo wey die for Port Harcourt, south south Nigeria.
Na few family members and friends attend di burial ceremony because of di coronavirus.
Among dem na di immediate family members of Ibidun and some friends of di family like di former Emir of Kano Sanusi Lamido and former Govnor of Oguns state Gbenga Daniel.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1
As per di church earlier announcement, di service dey on live for Arise TV for DSTV channel 416 and dey also dey stream for dia social media platforms Facebook, Twitter, Instagram and Youtube.
On Friday, Night of Tributes for di late pastor wife also show for live on AIT DSTV channel 253.
Na on Wednesday, 17, June, 2020 friends and family gada for di service of songs.
For di event, her daughter sing worship song while Pastor Ituah Ighodalo wey wear white also participate for di emotional worship.

Popular gospel artiste Tope Alabi na also one of di worshippers wey sing for di service.
End of Di one wey oda users dey read well well
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
Di sudden death of Ibidun on 14 June, 2020 shock pipo across di kontri and abroad.
Pictures from di service:

Wia dis foto come from, Trinity house church

Wia dis foto come from, Trinity house church

Wia dis foto come from, Trinity house church
Tributes begin dey pour in as di deadi bodi of Ibidun Ighodalo arrive Lagos afta her sudden death for Port Harcourt.
Di family of di late Ibidun Ighodalo bin carry her bodi go mortuary for Lagos Island, according to di General Manager of Elizabeth R wey be madam Ighodalo company.
Im say dem bin carry di bodi go di mortuary in di company of her husband, Pastor Ituah-Ighodalo and oda family members.
Tori be say madam Ighodalo, di former Nigerian beauty queen wey be wife to Pastor Ituah-Ighodalo of Trinity House church for Lagos, Nigeria, die on Sunday for her hotel room for Port-Harcourt, Rivers State southern Nigeria.
"All I know be say she go to bed last night but no wake up again dis morning" Lawal Nurudeen her colleague wey be Manager of Elizabeth R (her company) tell BBC Pidgin.

Wia dis foto come from, Ibidunni Ituah-Ighodalo
Oga Nurudeen wey travel wit her to Port Harcourt for official project say she die on Sunday morning inside her hotel room.
Evriday Nigerians dey also feel di pain of her death
Tribute from oda Nigerians dey also enter for her in celebration of her life and ogbonge work. Pipo dey tok of di kain pesin wey madam Ighodalo be during her life:
Lagos state Governor Babajide Sanwo-Olu bin express shock wen im hear di news say Pastor Ituah Ighodalo wey im call im padi, lose im wife. Di Governor say madam Ighodalo na inspiration to many pipo.

Wia dis foto come from, Babajide sanwo-olu
Former Vice president of Nigeria Atiku Abubakar also follow choke mouth say even tho her life fit don dey short, e bin get impact.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

End of X post, 6

End of X post, 7

Wia dis foto come from, TY Bello
Until her death, di former Miss Lux bin dey run Ibidun Ighodalo Foundation.
Na for February, di mother of two mark her 13th wedding anniversary wit her husband, Pastor Ituah Ighodalo of di Trinity House.
Di 39 year old former Nigerian beauty queen, wife and head pastor of Trinity House church, be businesswoman and marriage counsellor wey set up NGO foundation to give support to couples wey dey find pikin to born.
At about 1pm on Sunday, 14 June, di Instagram page of her church post black foto, wey fit mean say true-true dem don suffer big loss.
And her personal Instagram page wey up until di time tori break of her death get 76,000 followers, don dey closed down.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Her family don confam di death of di former beauty queen for statement wey Asue Ighodalo sign. Di family also tok say dem go share informate of her burial as time go on. But dem no mention di cause of death.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
See some tins wey you fit no know about her
- Wen she be 18-year-old undergraduate of University of Lagos, Ibidunni nee Ajayi, win Miss Lux beauty pageant.
- She be di founder of Ibidunni Ighodalo Foundation, di NGO wey dey raise awareness on infertility mata.
- For one 2018 interview, Ighodalo tok say she bin do IVF 11 times due to pressure from in-laws and friends.
- She bin dey run one of di successful event planning company - Elizabeth R - wey dey decorate Lagos during Christmas.