Sushant Singh Rajput death: Di Pavitra Rishta actor die for im apartment, but many suspect suicide afta Sushant manager Disha Salian die

Sushant Singh Rajput

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sushant Singh Rajput was perhaps best known for playing legendary cricketer MS Dhoni
    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, Senior Broadcast Journalist
  • Read am in 1 mins

Police confam say one of Bollywood superstar actor, Sushant Singh Rajput, don die for im Mumbai apartment.

Tori be say di thirty- four year old wey act for films like Kai Po Che and M.S Dhoni, bin dey suffer from depression.

But tori dey fly upandan say im take im own life.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Im former manager, Disha Salian, 28, die earlier dis week afta falling from di 14th floor of a building in Mumbai

Inside one Instagram story afta her death, Rajput write: "E dey so heartbreaking as news. My deepest condolences to Disha family and friends. May your soul rest in peace."

  • Pavitra Rishta television series
Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post

  • M.S Dhoni
  • Chhichhore
  • Dil Bechara - Rajput movie wey dem delay di release due to lock down
  • Kai Po Che - Di first film wey Rajput act

Na for di eastern state of Bihar dem born Rajput. Im drop out of one university course in engineering to pursue one career in acting and dance.

Rajput Bollywood breakthrough land in for 2013 film Kai Po Che, wey win for di Berlin film festival.

Di actor last film na Chhichhore, wey dem release last year. Di film's director Nitesh Tiwari say im be speak to Rajput last week.

Tributes don dey enta for India Bollywood star Sushant Singh Rajput wey die inside im Mumbai apartment.

India Prime Minister Narendra Modi for Twitter say shock catch am, as Rajput na bright young actor wey die too soon.

Rajput na 34 years old.