Oluwatoyin Salau: Toyin complain for Twitter before she miss, Tallahassee in Florida City Police find her dead bodi days afta - See wetin we sabi so far

Oluwatoyin Salau

Wia dis foto come from, @virgingrltoyin/Twitter

Wetin we call dis foto, Oluwatoyin Salau bin complain of sexual molestation for Twitter before police declare her missing three days later.
    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, Senior Broadcast Journalist
  • Read am in 2 mins

Police don find Oluwatoyin Salau deadi bodi days after she bin miss, according to wetin BBC Pidgin fit verify.

'Toyin' for short, na 19 year old US based Nigerian wey be activist and she follow do Black Lives Matter march for Florida, USA.

BBC Pidgin find out say di Tallahassee Police Department bin declare her missing on 9 June, 2020 but days later dem declare her dead on Monday evening 15 June afta dem find her deadi bodi in a case of homicide wey dem dey investigate.

Tori be say di 19-year-old activist bin miss afta she post complain for Twitter on 6 June say pesin sexually molest around Park Avenue and Richview Road, Tallahassee, Florida.

For di tweet Toyin say di man offer to give her a ride back to one church wia she dey go take cover sake of wetin she call her "unjust living conditions."

Dis na Oluwatoyin last complain before police find her deadi bodi;

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

According to di police report, at about 9:15 pm Saturday night, 13 June, 2020, TPD investigators arrive for 2100 block of Monday Road to follow up investigation wey concern one missing pesin (referring to Oluwatosin Salau) case.

During di investigation, two dead bodi tanda for di area, di statement add. Police say dem find her bodi wit one oda 75-year-old woman near Wahnish Way and Orange Avenue, Tallahassee..

Oluwatoyin Salau

Wia dis foto come from, Screenshot/Twitter

Oluwatoyin Salau na prominent voice in protests over police brutality. Dem also identify suspect wey di police say dey dia hand now.

As di investigation continue, investigators develop a suspect. Police say suspect dey in custody now and no more information dey available for now.

Di deaths Oluwatosin Salau and di 75 year old woman, police say dem dey investigate di mata as homicides and dem don hand over to di TPD Violent Crime Unit.

Investigators dey ask anyone wit information about dis case to call dem on; 850-891-4200 or Crime Stoppers at 850-574-TIPS.

Tallahassee Police Department public notice

Wia dis foto come from, Other

Oluwatoyin Salau

Wia dis foto come from, @virgingrltoyin/Twitter

Wetin we call dis foto, Many pipo don begin sign petition to demand justice ontop her mata wit di hashtag #JusticeForToyin

Nigeria goment dey call for investigation ontop Toyin death

Authorities for Nigeria dey provoke on di death of di Nigerian-American activist.

Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) oga-madam say wetin dem consider as di murder of 19-year- old Toyin Salau inside di US as highly depressing and cruel.

Abike Dabiri-Erewa, di Chairman/CEO of NIDCOM don call on di US government to conduct thorough investigation on all di tins wey lead to Miss Salau death.

Di NIDCOM oga madam send sorry message to di immediate family of Ms Salau wey die while she dey campaign against oppression and injustice.