Lockdown update in Nigeria: Wetin go happun next?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di number of confam cases of coronavirus for Nigeria don officially pass 10,000.
As at Sunday 31, May 2020, 35 states for di federation including di FCT don record cases. Of all dis, Lagos state dey lead with over 4000 cases.
As di number of confam cases continue to dey rise for di kontri, especially for Lagos, Abuja and Kano, President Muhammadu Buhari for nationwide television broadcast bin order 14 days lockdown for Lagos, Abuja and Ogun states. Afta di end of di 14 days, di president bin order anoda ban of movement for dis states for anoda 14 days to take check di spread of di virus.
Some oda states also follow dis way, order lockdown to take control di spread of di virus for di kontri.
Across Nigeria, di partial lockdown or curfew don make pipo siddon for house or work part time, even affect schools, businesses and religion.
So pipo don dey ask wen di mata go end.

Wia dis foto come from, TWITTER
Wetin we know
Di Chairmo of di Covid-19 Presidential Task Force Boss Mustapha bin meet wit President Muhammadu Buhari to discuss di next phase of ease of lockdown.
Oga Mustapha tell tori pipo afta im meeting wit di president say, states go now manage di pandemic while di Federal goment go coordinate tins.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im say "I fit assure you one tin, di ownership of di next phase go be di responsibility of di states under national supervision and coordination, becos we don enter community transmission.
"Wia di communities dey? di communities dey for di states, so di ownership of di next phase go be dat of di states, local goment and traditional institutions..."
Wetin states already dey do
Already some states for Nigeria don partially lift lockdowns and also put in place some measures to handle di controlled reopening of dia economy.
Just before Eid el-fitr celebrations, northern states for Nigeria like Kano, Borno, Zamfara, and Jigawa bin ask mosques and churches to reopen but must observe social distancing, wearing of face mask and washing of hands.
For Lagos state wey get di highest number of Covid-19 for Nigeria, wearing of face masks for public places dey compulsory.
Buhari go extend di partial lockdown?
As e be so, pipo for social media don begin ask weda federal goment go extend dis ease of lockdown or not and how e go take affect dem if anoda extension go dey.
Di ansa never clear for now. But las-las, di mata dey for di hand of President Muhammadu Buhari.
Either by nationwide broadcast or through statement by di Presidential task force for dia daily briefing or any oda means, Nigerians go know dia fate sometime, weda dem go continue to siddon for house or if goment go lift di lockdown.













