To rinse mouth wit salt and water dey prevent Covid-19?

Wetin we call dis Video, To rinse mouth wit salt and water dey prevent Covid-19?

Maybe dem don share message or photo to you wey claim say if pesin rinse dia mouth wit warm water and salt, or vinegar, e go clear di coronavirus (fiam fiam).

Na lie o.

International health experts no send anybodi dis kain message as way to treat or prevent coronavirus.

And no gist get am say, di virus fit dey pesin mouth for 4 days before e enta di lungs.