Coronavirus: Garlic, Ginger and Onion no fit prevent Coronavirus

Wetin we call dis Video, Coronavirus: Garlic, Ginger and Onion no fit prevent Coronavirus

Some videos for internet dey claim say if pesin dey chop dis kain food, dem go dey all right. But no health benefits of di herbs fit prevent coronavirus; no ogbonge informate dey say e dey help.

Today episode of ‘covid-19 in 60 seconds’ dey chook eye for dis fake claim.

Make una always remember to wash your hands wit soap and water for at least 20 seconds.