You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Coronavirus: Boris Johnson test positive to Covid-19
UK Prime Minister Boris Johnson don test positive to coronavirus.
Dis one na tori wey dey comot from di domot of Downing Street. Im symptoms no strong well-well and e say im go continue to dey lead di goment, as dem dey respond to di virus.
E dey on self-isolation.
Inside video e post for twitter, e say e don develop small-small symptoms come test positive to coronavirus.
Boris Johnson bin do get close contact with di goment chief scientist and all of di pipo wey dey in charge of to dey handle how di goment dey respond to di coronavirus palava.
Di prime minister dey well enough to continue work with technology, so for now, he no dey march break from im job.
In case of anything, Foreign Secretary Dominic Raab dey on standby, e go step up if Boris Johnson need to take time off work. For now, Mr Johnson still dey in charge.