Coronavirus: Markets for Accra on shut down for disinfection exercise against covid-19

Ghana go clean up markets

Major disinfection exercise dey go for all markets wey dey Ghana capital, Accra as part of moves wey government wan use to manage de spread of coronavirus.

Hundreds of markets and satellite markets wey develop along lorry stations all dey under lockdown after government direct say make dem lock all shops for dis exercise.

Minister of Local Government, National Disaster Management Organization with support from Ghana Armed Forces enter all market spaces for de disinfection exercise against coronavirus.

BBC Pidgin speak plus Korle Klottey Municipal Chief Executive, Nii Adjei Tawiah who explain say "we dey disinfect wanna markets for here, we get like 14 markets for dis municipality."

"We plan de whole tin for just today, but we face small challenges so sometimes if we no finish today then we go finish am morrow."

Ghana go clean up markets

Checks from BBC Pidgin for various markets show say most shops dey under lock and key.

Over 1000 officials plus de Emergency National Disinfection Exercise against covid-19 dey ground for de exercise.

Ghana record 24 confirmed cases of coronavirus, out of which one person die.