Coronavirus: Ghana ban travellers from kontris wey record over 200 covid-19 cases from entry

President Nana Akufo-Addo

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Ghana President Nana Akufo-Addo
Read am in 2 mins

Government announce new travel advise give all travelers after de country record four new cases of covid-19 from travelers wey enter de country.

According to Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah, dem give airlines strong instructions say make dem no allow people wey travel from countries wey get over 200 cases of COVID-19 from joining dema flights to Ghana.

"We strongly discourage all travels to Ghana at dis stage until further notice."

"Any traveller unless dem be Ghanaian citizens wey visit kontri wey record at least 200 cases of COVID-19 no go enter de Ghanaian jurisdiction" Mr Oppong Nkrumah talk.

Govment make dis announcement for press briefing under today after de country record four new coronavirus cases which increase total cases to six for Ghana.

Authorities also say dem dey strongly discourage Ghanaians from travelling around dis time sake of de outbreak.

If you no dey fall inside de category wey dem bam, authorities say you for go through mandatory 14 days self quarantine.

Dis go help reduce possible infection of other people if such travellers like Ghanaian citizens wey enter de country get de virus low key.

President Akufo-Addo last week announce $100 million monies wey de country go take deal plus coronavirus.

Authorities for Ghana say dem dey step up dema plans to deal plus dis global pandemic.

University of Ghana suspend lectures

University of Ghana (UG) say dem suspend lectures for campus after one of dema students test positive for coronavirus.

According to de University, de non-residential student return to Ghana from international trip.

Dis student be one of de cases wey increase Ghana covid-19 cases to total of six.

Sake of de case wey dem record management say dem dey suspend all University of Ghana campuses, including clinicals and practicals, with immediate effect.

"As a result of de suspension all students, staff who dey leave outside UG campuses wey dem currently dey off campus for stay away from de school until further notice" de official statement from Registrar reveal.

Meanwhile, Vice-Chancellor, Professor Ebenezer Oduro Owusu also make de announcement give students for de campus radio top, Radio Universe.

University of Ghana et student population of about 40,000, some be resident students while others be non-resident.

Management of de school advise students say make dem practice safety measures like distance from people wey dem also suspend de hosting of international visitors until further notice.

De University say dem provide hand sanitizers give students for de various halls of residence.