Coronavirus Fake News: BBC never report say Ghana confam first case of Covid-19

BBC Pidgin banner on Coronavirus

BBC want draw attention of de public to fake story which dey make rounds say "Coronavirus: Ghana confirms first case in the University of Ghana" be fake.

De perpetrators write fake story wey dem put BBC News branding for top.

BBC News want state clearly say dis story no be true, so make everyone ignore as Ghana no record any case of coronavirus.