Coronavirus symptoms: Ghana don record first cases of Covid-19 outbreak, patients enter Ghana one week before symptoms start dey show

Wia dis foto come from, Other
Ghanaian authorities say dem don start di process of tracing everyone wey bin contact di first two patients wey test positive for Covid-19 disease.
Health Minister Kwasi Agyemang-Manu wey confam di first two cases on Thursday night announce say both individuals enter Ghana from Norway den Turkey.
"We start de process of contact tracing. We want assure Ghanaians say Govment den health partners go make sure de situation be contained" Mr Manu add.
BBC Pidgin find out say di two coronavirus patients enter Ghana for like one week before symptoms start dey show.
Both patients according authorities dey Ghana for one one week before de virus finally start dey manifest. De Ghanaian dey work outside de country but en flight come from Turkey into Ghana.
According Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah reveal "yeste dem complain of symptoms so dem place place inside isolation."
"Noguchi test dema blood samples wey somewhere around 7.00pm dat be when filla drop say dem test positive for de virus inside meeting" he add.
Doctors start treatment on de two soon as de results come.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say dem don keep di two patients wey get di coronavirus for isolation alias separate ward, althogh nobody know where di ward dey.
Health Ministry for Ghana set up 100-bed capacity facility inside one remote area to quarantine suspected cases.
De two cases test positive after laboratory tests from de Noguchi Memorial Institute of Medical Research on 12 March, 2020.
Ghana Ministry of Health say dem dey for stable condition.

On Wednesday Ghana step up preparations and response plan to deal with coronavirus plus $100 million dollar financial commitment.
Prez Akufo-Addo announce Wednesday night inside national address say he direct en finance minister make he release dis fund.
Dis monies go "expand infrastructure, buy materials and equipment, and public education" Akufo-Addo explain.
During de address Ghanaian leader also urge nationals make dem shun dey foreign travels for now.
"All of us for shun foreign travels, except de most critical ones until de virus matter finish" President Akufo-Addo talk.












