Court order Sanusi Lamido release from Nigeria Police, DSS detention

Emir Sanusi Lamido

Wia dis foto come from, Twitter/@masarautarkano

Read am in 2 mins

Nigeria federal high court for Abuja, don order di kontri security agencies to free one dethroned king for northern part of di kontri, wey dey on exile.

Former emir Lamido Sanusi bin carri Nigerian goment go court to challenge why police detain am for Awe, one town for Nasarawa State (north central Nigeria) afta Govnor Abdulahi Ganduje of Kano State for north west region remove am as di 14th Emir on Monday and replace am immediately with anoda king.

Dis na foto on Friday wen Kaduna State Govnor wey be friend to Emir Sanusi go visit am for Awe, Nasarawa State (north central Nigeria).

Wia dis foto come from, Twitter/@GovKaduna

Wetin we call dis foto, Dis na foto on Friday wen Kaduna State Govnor wey be friend to Emir Sanusi go visit am for Awe, Nasarawa State (north central Nigeria).

Justice Anwuli Chikere give di order afta Sanusi lawyer Lateef Fagbemi carry di mata go court on Friday.

Pipo wey dis mata concern na di Inspector-General of Police, Muhammed Adamu; di Director-General of di Department of State Service, Yusuf Bichi; di Attorney-General of Kano State, Ibrahim Muktar, and di Attorney-General of Nigerian goment, Abubakar Malami (SAN).

Di Judge fix March 26 to hear di case.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Why Sanusi go Awe town?

Na banishment culture for Kano Emirate inside northern Nigeria for any deposed king to go on exile after dem remove am.

One tin wey fit happen to Sanusi na say e fit no get chance to enter im town again if di political power wey im offend no forgive am.

Sanusi grandfather wey chop sack in 1963 no fit enter im town for about seventeen years until former governor Abubakar Rimi forgive am.

According to history na di new king Ado Bayero wey replace come give am house.

We no know if Sanusi II fit get di same fate as im grandfather but dat go depend on weda Ganduje forgive am and di junior Ado Bayero wey be di new Emir of Kano Aminu ef con give am house.

E go be history on repeat.

Di new place where di exiled King go serve im banishment Awe Nasarawa State
Wetin we call dis foto, Dis na Awe Nasarawa State (north central Nigeria) -Di new place where di exiled King Sanusi Lamido go serve im banishment

BBC tori pesin wey cari eye dis new domot of di deposed Emir for Awe Nasarawa State (north central Nigeria) tok say na contingent of 'overzealous' policemen dey guard Sanusi Lamido. Apart from one of im wives and some of im pikins, no visitors don dey allowed to see am, our tori pesin report on Wednesday evening.

Even two traditional rulers from Karshi (Dr. Muhammad Sani Bako), and di Yakanajin Uke, Alh. Ahmad Abdullahi, dem no allow dem to see am wen dem visit.