International Women Day: Five ways men and women no dey equal for Nigeria

Wia dis foto come from, AFP
One UN study wey comot on Thursday show say almost 90 percent of pipo for di world, both men and women dey biased against women, even as dem dey try close di gender equality gap.
For Nigeria, women dey make up 49% of di kontri population but neva still get di same rights as men.
Make we check out some of di ways Nigerian man and woman no dey equal.
Citizenship rights
Section 26 (2) (a) of di 1999 Constitution give di right of citizenship to any woman wey marry Nigerian man but no be so for Nigerian woman.
Many pipo don vex say e be discrimination of dia nationality rights sotay dem tok say e fit cause mental kata-kata.
But one member of House of Reps, Hon. Akin Alabi dey di process to change dat kain law, and di bill pass first reading on February 27.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Child Marriage
Nigeria get one of di highest case of girl child marriage for di world. UNICEF tok say e pass 40% of women for di kontri wey dey marry before dem clock 18.
And di law permit am. Section 29 (4) (b) of di 1999 constitution wey dem amend tok say "any woman wey don marry go dey seen as adult." Na Muslims dey support di bill pass on top say dia law no tok wetin adult be for marriage.
End of Di one wey oda users dey read well well
But di federal goment don adopt di Child Right Act (2003) wey make child marriage illegal and minimum age for marriage to increase to 18.
But di CRA no go fit work for Nigeria because say e go against wetin dey di Nigerian constitution.
Widowhood
For Nigeria, women na husband property as dem see am and afta di husband die, dis mentality fit lead to violation of her human rights, all for di name of culture.
Men no suppose to show any sadness or emotion for public when dia wife die unto say, head of family but for woman na different mata.
For some parts of Nigeria, women na first suspect if dia husband die and need to prove her innocence for ways wey mouth suppose no tok, odas dey show rape of woman and shaving of hair for mourning period.
To rent house
To rent house for many parts of di kontri na serious palava for single women wey need to bring men to prove say dem be responsible women so dem go fit get place to stay but no be di same for man dem.
Dis na because many landlords tink say woman no suppose comot from her papa house till she marry, which dey cause wahala for women wey wan work.

Wia dis foto come from, Getty Images
Family Planning
Di way culture dey play role for society for Nigeria na one of di reasons family planning no dey work.
Na only 13 percent of women wey dey relationship or don marry within di age of 15 to 49 dey use contraceptives.
Di issue be say for many parts of Nigeria, mostly for north na di man decision weda woman go do family planning and wetin come bad pass be say wen di man decide, sometimes dem no go tell her.













