Women's Day: Explosion don spoil de day for Bamenda - Cameroon

Bamenda pipo dey protest how francophone majority dey benefit pass for Cameroon - September 22, 2017 in Bamenda

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo for Bamenda form part of di Anglophone region of Cameroon wey accuse di Francophone of oppression
Read am in 1 mins

Tori for dis women's day from Bamenda na say local bomb explode for commercial avenue grand stand as woman dem for 'Abakwa' go march.

De explosion happen as governor for Northwest region Adolph Lele L'Afrique bi di make e speech.

Dis cause total panic as all woman dem start run for hide.

For now local media report say about 10 pipo get wound from de bomb explosion.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

For now governor nova give official tok as to weti happen.

Kontri pipo di suspect separatist fighters for de explosion.

Just now reports say some house opposite grand stand for commercial avenue for Bamenda catch fire.