Coronavirus: Nigeria don isolate three pipo sake of wetin fit be new case of Covid-19

Test equipment for coronavirus for Airport

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Di health commissioner for Nigeria commercial capital, Lagos, don confam say dem don isolate three pipo wey dem suspect say e fit get coronavirus.

Di three pipo dey one isolation centre for Yaba, make dem for fit prevent dem for possible spread of di virus. Dem don collect dia samples and dem go release di result later.

Prof Akin Abayomi, tok say one of di 3 na Nigerian wey enta di city on Monday afta dem spend seven days for France and dem later come back with headache and respiratory symptoms.

Di oda cases na travellers from England and China.

Prof Abayomi tweet about di three cases:

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Earlier on thursday, di commissioner bin announce say one man wey just enter Nigeria na suspect for coronavirus.

Prof Akin Abayomi say di Nigerian man come back with headache, and say e dey hard am to breathe but im no get fever.

"We no dey take chances. Active transmission (to infect anoda pesin) dey happun for France now. We don isolate am and we dey run di test"

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Nigeria confam im first coronavirus case on 27 February.