You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kobe Bryant: Di Basketball legend don die for helicopter crash - reports
Read am in 1 mins
Kobe Bryant, di ogbonge basketball star wey spend 20 years wit di Los Angeles Lakers, die on Sunday, US media dey report.
Tori be say di 41-year-old die inside helicopter crash as im be dey travel around one place wey dem dey call Calabasas.
Oga Kobe die with im 13 year old daughter, Gianna for inside helicopter crash for California.
Many pipo don dey react on top di death of di basketball star and im pikin.
How di World dey react to Kobe death?
We don update dis tori with new informate.