UK-Africa Summit 2020: Deals wey Nigeria, Ghana sign for di London investment meeting

Wia dis foto come from, @BashirAhmaad Twitter
- Author, Fiona Equere
- Role, BBC News Pidgin
British goment sign 27 commercial deals wey reach ova £6.5bn across Africa market afta di first ever UK-Africa Investment Summit for London.
Tori be say dis summit na strategy for UK to become di biggest investors for Africa even though trade volumes between kontris like China and India for Africa don grow well-well.
British goment bin don already sign 11 trade agreements wit African kontries, just a week before dem go officially waka comot from di European Union
Di first ever investment meeting between UK and African kontris bin start on Monday January 20 and na UK Prime Minister, Boris Johnson na im go open di summit wey 21 African kontries attend.
See di deals between UK companies and African partners here:









