Sultan Qaboos of Oman: Five tins you need to know about Arab longest-serving ruler

Sultan Qaboos na di longest-serving Arab ruler for di world

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Sultan Qaboos na di longest-serving Arab ruler for di world

Sultan Qaboos bin Said Al Said of Oman, di longest-serving Arab ruler for di world, don die at di age of 79.

"With great sorrow and deep sadness... the royal court mourns His Majesty Sultan Qaboos bin Said, wey die on Friday,"dat na according to statement wey di court release.

Last month im return home afta im medical treatment for Belgium. Tori be say im bin dey suffer from from cancer.

Di Kontri don declare three days of national mourning for am.

Dem don swear in di culture minister of Oman, Haitham bin Tariq, as im successor, Di monarch no get heir but name in cousin as im successor for inside one letter wey dem open for official ceremony for Muscat.

Dis na tins you suppose know about Sultan Qaboos bin Said Al Said of Oman

Qaboos bin Said Al Said, in military uniform, circa 1970

Wia dis foto come from, Keystone

Sultan Qaboos no marry and no get any pikin or anybody wey go succeed am.

For 1970, at di age of 29 di Sultan overthrow im father, Said bin Taimur, for one bloody coup with di help of British support. Tori be say im father rule Oman with strong hand.

Di sultan na paramount decision-maker for Oman. Im also hold di position of Prime minister, supreme commander of di armed forces, minister of defence, minister of finance and minister of foreign affairs.

Di monarch use di kontri oil wealth to arrange Oman path to development.

Sultan Qaboos bin Said Al Said of Oman na di longest serving Arab ruler for di world. Im rule for almost fifty years.