Iran vs USA: Wetin you need to know about di military power wey US and Iran get

Military trucks carrying Iranian missiles

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Military trucks wey carry Iranian missiles
    • Author, Princess Igho Williams
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Read am in 3 mins

Di kwanta between United States of America and Iran don make words and hash tags like 'World War III,' '#IranVSAmerica', '#IranAttacks' and so on begin dey trend worldwide for many days ontop different social media platforms.

Tension full ground afta Iran fire US troops missile on Wednesday as do me I do you attack to reply di US airstrike wey kill Iranian General Qasem Soleimani on Friday.

As di mata be so, pipo all over di world dey worry and fear say dis tension between Iran and America fit lead to something else.

Latest tori be say US Presido Donald Trump don come outside beat chest say America ready to make peace wit pipo wey wan make peace. 'Iran be like say dem dey don cool down, e add.

Meanwhile US president, Donald Trump don already tweet say America go send some of dia brand 'new beautiful equipment go Iran, if dey try to attack any American Base or dia citizens.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

So wetin we know about di military power of Iran and United state of America?

Di Military capability of Iran and US

One online military ranking website, Global Firepower Index rank United state of America as number 1 for di world out of 137 kontries for dia 2019 military strength report, while Iran dey number 14 position. Dem say di major kontries wey dey compete with America defense na Russia and China and dis dey put United state under serious pressure to spend, modernize and change dia defence plan.

Iranian missiles on display

Wia dis foto come from, Getty Images

Which missiles Iran get?

Iran missile systems na key part of dia military gun power because of say dem no too get air power unlike Israel, Saudi Arabia, US and UK, wey get technology to carry out correct air strikes.

Iran no get dis strenght and so dem dey rely on launching missiles.

Iran's ballistic missiles and ranges

One US Defense Department report describes Iran missile forces as di largest for di Middle East, and e include short and medium-range missiles.

Dem also say Iran dey test space technology to allow dem develop inter-continental missiles, wey go fit travel far more .

Iran get nuclear weapons?

A woman looks at missiles on display during a street exhibition in Tehran, Iran

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Iran missile capabilities na key part of dia military skill

Iran no currently get nuclear weapons programme, and don bin tok say dem no want one. But dem get many of di elements required and di knowledge to create military nuclear capability.

For 2015, di US goment under President Obama estimate say Iran only need two to three months to produce enof nuclear material to make a weapon.

Di nuclear agreement dat year between Tehran and six world powers - wey President Trump withdraw from for 2018 - introduce limits and international checks on Iran nuclear activities.

But afta di killing of General Soleimani, Iran say dem no go follow dia restrictions.

Which missiles America get?

Rockets on Display for Air Force Exhibit, Point Magoo, California

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rockets on Display for Air Force Exhibit, Point Magoo, California

According to NationMaster, one online statistics database wey dey do ogbonge compare of dis kain informate, America get di capability to produce highly strong liquid- and solid-fueled missiles of all ranges.

Di heritage site report say di U.S. Minuteman III intercontinental ballistic missile (ICBM) fit carry up to three nuclear warheads.

America get nuclear weapons?

As one of di five recognize nuclear weapons states under di Nuclear Non-Proliferation Treaty (NPT), United States maintain ogbonge gun power of nuclear weapons, including warheads.

World population review report say only nine major kontries na im currently get nuclear weapon and dem be:

Russia (6,850 nuclear warheads), United States (6,185 nuclear warheads), France (300 nuclear warheads), China (280 nuclear warheads), United Kingdom (215 nuclear warheads), Pakistan (145 nuclear warheads), India (135 nuclear warheads) Israel (80 nuclear warheads) and North Korea (15 nuclear warheads).

United States conduct dia first nuclear test explosion for July 1945 and drop two atomic bombs for di cities of Hiroshima and Nagasaki for August 1945.