UFC 245: Kamaru Usman fight with Colby Covington wetin you need to know

Wia dis foto come from, Kamaru Usman
Nigeria Welterweight champion Kamaru Usman, go fight Colby Covington for UFC 245 inside octagon for Las Vegas, United States on Saturday night.
Tori be say na three title fights go happun but na Kamuru fight na im be di main event of di night, sake of say di two fighters don dey eye each oda since.
UFC na di biggest competition for MMA, wia di fighters dey combine boxing, kickboxing, jiu-jitsu, wrestling and every- every wen dem dey fight.
Dis na wetin you gatz know about Kamuru Usman UFC fight with Colby Covington

Usman Kamuru

Wia dis foto come from, Getty Images
Kamaru Usman na di first African fighter to win Ultimate Fighting Championship title.
Di Nigerian neva lose for im last 14 fights for UFC.
Im record na 15-1.
Usman get six career knockout win and one submission victory.
Dis na wetin Usman tok about di fight: Im say "If you want to be champ, you go show up for di champ open workout and try to distract dem, right? Why you show up for my own? Because im know say e go happun.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Im know say I be di most dangerous guy for di division and im know bin want fight. So im don dey show imself no be today.
"I dey relaxed becos I know wetin I go do."
Colby Covington

Wia dis foto come from, Getty Images
Colby Covington na former interim champion.
Im record na 15-1.
Covington get four career win by submission and three knockout victory.
Di American neva lose for im last seven fight.
Dis na wetin Covington tok before di fight : "All di tins I dey tok na true, and if pipo dey feel one kind dis no be di (Ultimate) Feelings Championship na di (Ultimate) Fighting Championship, so I go do anytin to take sell di fight na wetin I gatz do.
"I dey real. Plenti fighters dey fear to fall .Me I know dey fear to fall becos I know say I be winner and I go continue to win."

Wia dis foto come from, Getty Images
Tori be say Usman and Covington go make $500,000 each for dis dia fight.












