You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Fireboy DML album make pipo do wow!
Read am in 2 mins
Nigerian artiste Adedamola Adefolahan wey pipo sabi as Fireboy DML cause commotion ontop twitter with di release of im first album Laughter, Tears and Goosebumps on Friday, November 29, 2019.
Di young musician first make im mark with im song 'Jealous' wey release for 2018.
Na on October 16, 2018, Nigerian rap superstar, Olamide sign di "afrolife" singer to im record label, YBNL.
Since di song land, pipo don enta social media to tok dia mind.
Since di song drop, pipo don also begin compare Fireboy, Joe boy and Rema, three young musicians wey dey currently make waves for Nigeria music space.