You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Picazo: Olamide YBNL don sign rapper afta im freestyle video go viral
Read am in 1 mins
Ogbonge Nigerian rapper Olamide don sign Picazo enta im record label, YBNL.
Di young Nigerian boy, Picazo bin trend well-well for social media afta plenti pipo begin share video of am wia im dey spit bars for Yoruba.
Di video too burst pipo head sotay like play like play, Olamide sef see di video come sign di boy to im record label on Sunday night.
Some pipo wey dey happy for di latest YBNL artiste begin hail am.
But some oda Nigerians no too sure about di move.