Burna Boy decision to go perform for South Africa dey make fans clash

Read am in 2 mins

No be new gist say Burna Boy dey go perform for South Africa dis November but na di 'African Giant' U-turn to go di rainbow nation dey make fans clash.

E announce am on top social media on Saturday wey make many pipo begin fear and para at di same time.

You sef tink am, Burna bin tok say im no go go South Africa sake of di Xenophobic attack (wey be attack against foreigner) for di kontri.

On Thursday, SA rapper AKA post say make im apologize give di kontri before dem even think say dem go let am enta di kontri. Dis na as AKA say e go beta pass if Wizkid come instead of am.

Di "Anybody" musician bin don announce before say im no go South Africa afta xenophobic attack for di kontri cari plenti-plenti pipo come back Naija from di kontri.

On Thursday, SA rapper AKA post say make im apologize give di kontri before dem even think say dem go let am enta di kontri. Dis na as AKA say e go beta pass if Wizkid come instead of am.

Wizkid dey go dia next month.

Fans clash

Pipo don dey tok for social media wetin dem tink about Burna Boy concert for South Africa.