Sowore: DSS say nobody show to collect Sowore, Deji Adeyanju volunteer

Omoyele Sowore

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Department of State Services (DSS) on Friday say nobody show to collect Omoyele Sowore from dia hand but lawyers of di #RevolutionNow campaign say na lie.

Ogbonge Nigeria lawyer Femi Falana, wey dey represent Sowore, reply late di same say on 8 November say: "SSS decide not to release our clients to our lawyers afta dem wait in vain for di agency headquarters for no less than 4 hours," according wetin local tori The Cable quote for am.

For statement wey di DSS comot on Friday, dem give assurance say dem go release Sowore as per di court order, say dem no go "ever obstruct justice".

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

By Saturday, 'Sowore' don dey trend for social media as pipo begin wonder why DSS need to release di former presidential candidate like say im na object.

Popular I-no-go-gree Nigerian Deji Adeyanju - wey im sef dey DSS custody for over two months - tweet say on Saturday morning say im dey front of DSS office for Abuja to 'collect' Sowore.

For live stream on Facebook Adeyanju say dem go do sit-in for di front of DSS office until dem release Sowore. Say if DSS excuse na say e be weekend, dem go dey dia on week day di following week, "after all many of dem don already become customers."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2