Beyonce papa Mathew Knowles say im get breast cancer

Wia dis foto come from, Getty Images
Mathew Knowles, di papa of American pop singers Beyonce and Solange Knowles, tok say im get breast cancer.
Knowles tok say im doctor confam am early dis year say im get breast cancer.
Di 67-year-old tok for Good Morning America say im dey do well afta surgery wey im do for july.
Knowles tok say im go meet im doctor for mammogram afta im dey see blood for im cloth and im bed cloth.
Im tok say e bin dey ask why di tin happun to am wen e hear say e get di sickness.
"Of everytin wey I fit get, why I go get dis kain tin?" E tok give GMA tori pesin Michael Strahan.
Male breast cancer no dey common and e dey happun for men wey don pass 60.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Knowles say di way im dey look di world don dey different as im go dey "very much aware and conscious" for di rest of im life.
"Tins wey mata to me before no mata to me again," E tok for interview for ABC network on Wednesday.
Knowles, wey bi former Xerox salesman, become popular wen im put Destiny's Child togeda, di band wey torch light im eldest pikin Beyonce to become star. E also manage her solo career till 2011.

Wia dis foto come from, Getty Images
E divorce Beyonce and Solange mama Tina for 2011 come born two more pikin with im second wife Gena afta that.
"Di first call wey I make nah to my wife, Tina and my pikin dem," Na so he tell GMA tori pipo "My wife, Gena, don already know.
"I wan continue to dey make pipo dey aware make dem for detect am early weda you be man or woman"
"I need make men speak out if dem don get breast cancer," he tok. "I need make dem allow pipo to know say dem get di disease, so we fit correct di numbers and make we for do research"
"Men wan hide am, because di tin dey embarrass dem - and reason no dey for dem to be like dat." Im tok.
Why men fit get breast cancer

Wia dis foto come from, Getty Images
Breast cancer for men no dey common as e dey for women - for UK na 319 men get breast cancer for 2017 when women wey get am na 46,000, dis na wetin UK office for national statistics tok
Sabi person, Dr Omadeli Boyo tok give BBC pidgin say "Globally na 1% of breast cancer cases dey happun to men wey dey between 60 to 70 years for age."
Im say wetin fit cause am, na say e fit dey some men gene - pesin for dia family fit don get am before. Dr Boyo add am say "man wey dey exposed to radiation, radiography and men wey get hyper estrogen fit get breast cancer".
"Dem go dey feel lumps for dia breast, water-water tin go dey comot for dia nipple and di nipple fit dey go inside- dis nah wetin men wey get breast cancer go dey see as symptoms".
"To prevent am e go good make men dey eat well, dey exercise and make dem dey visit hospital to check diasef everytime with di doctor."
"If we see say man get breast cancer, depend on di stages wey di tin dey, we fit do chemotherapy- give am anti cancer drugs or we fit do mastectomy- surgery to comot di breast " Dr Boyo tok.












