Robert Mugabe: Buhari, Obasanjo, Mnangagwa pay tribute to di former Zim leader

Wia dis foto come from, Edgar Lungu Twitter
African leaders dey pay tribute to former Zimbabwe president Robert Mugabe wey die on Friday 6th September at di age of 95.
Nigeria president Muhammadu Buhari tell Mugabe kontri pipo sorry for di death of dia former leader. For inside statement Buhari say Mugabe sacrifice well-well for im pipo, especially for dia political and economic freedom and say history no go forget am.
President Emmerson Mnangagwa wey take ova power from Robert Mugabe afta military remove am from office for 2017, call Mugabe icon of liberation.
Mnangagwa tweet say "Mugabe contribution to di history of our nation and continent will never be forgotten."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Former Nigeria presido Olusegun Obasanjo say of Mubage: Africa don lose ogbonge freedom fighter, "wey sabi wetin e take to fight for liberation".
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Zambia president Edgar Lungu say dem go remember Mugabe for how im defend Africa.
South Africa goment hail di former Zimbabwe leader as "fearless pan-Africanist liberation fighter". For inside tweet wey dem send dem tell di kontri sorry.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Kenya President Uhuru Kenyatta call di 95-year-old "elder statesman, freedom fighter and pan-Africanist wey play major role to shape di interests of African continent".
End of Di one wey oda users dey read well well
"We go remember di former President Mugabe as man wey get courage wey no dey fear to fight for wetin im believe even when plenty pipo no like am," na wetin Uhuru Kenyatta tok for inside statement.
Tanzania President, John Magufuli tweet for Swahili say "Africa don lose one of di strong leaders wey fight colonisation."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Former commonwealth secretary general Emeka Anyaoku tell BBC say im go remember Mugabe as one of di great symbols of African liberation struggle.
Oga Anyaoku say di former leader promote di welfare and rights of im pipo wey suffer under di white minority regime of Rhodesia.
Former Minister of Forestry and Wildlife, Director for Cameroon Peoples Democratic Movement, CPDM party Academy, Prof Elvis Ngolle Ngolle bin see Mugabe wen e follow President Biya for United Nations General Assembly, France-Africa Summit and the Africa Union summits.
For am "Mugabe bin bi liberator for yi pipo, and e bin get dem for e heart, even if for everi day politics problems bi dey, laik for every oda kontri. Mugabe bi be na Pan Africanist, pesin weh e bin wan make Africa unite, e fight for take over from colonial masters, and na one leader weh Africans bin bi proud of".












