Zimbabwe former President Robert Mugabe don die at di age of 95

Wia dis foto come from, AFP
Zimbabwe former President Robert Mugabe don die at di age of 95.
Family member confam to BBC say Mr Mugabe bin don dey hospital for Singapore since April wia im bin dey battle with sickness.
Mugabe comot power afta one military coup for November 2017 afta more dan 30 years in power.
Im win Zimbabwe first election afta independence to become prime minister for 1980. For 1987, im cancel di office of prime minister to become president instead.
Im lead Zimbabwe from 1980 to 2017 wen e vice Emerson Mnangagwa replace am from office with di help of di military.
Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa, don express im sadness say Mugabe na di founding founder of Zimbabwe and icon of liberation.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Robert Mugabe - important dates
1924: Dem born am
Im later train to become teacher
End of Di one wey oda users dey read well well
1964: Rhodesian goment imprison am
1980: Win post-independence elections
1996: Marry Grace Marufu
2000: Lose referendum, pro-Mugabe militia dem invade farms wey white pipo get and attack opposition supporters
2008: Come second inside first round of elections to Tsvangirai wey pull out of di run-off as im supporters dey suffer nationwide attacks
2009: As di economy dey collapse, e swear in Tsvangirai as prime minister, wey serve for four years
2017: Sack long-time padi-padi Vice-President Emmerson Mnangagwa, to make way for im wife Grace to collect power afta am
November 2017: Army enta, force am to step down











